Friday, 15 May 2015

Plenty things Mango dey do for our Body


Our market don full with different types of fruit but d 1 wey u go see pass for market now na mango sake of say na the season #namangoseason.
Oya make i give una 10 things wey go make us dey chop Mango everyday;

1. E dey prevent CANCER::      E dey protect against Cancer, Leukemia, and Prostrate cancer

2. E dey lower CHOLESTEROL::    E get high level of vitaminC and e dey help lower serum cholesterol

3. E get high IRON for women::      Mango dey rich in iron. E get natural solution for people wey dey suffer from Anemia. E dey increase both iron and calcium level for both pregnant women and women wey don reach menopause.

4. E dey protect EYE::    1 slice of Mango dey supply 25% of vitamin A wey we need daily for our eyes, e dey even prevent night blindness and dry eyes.

5. E dey help DIABETES::  E dey help the insulin level wey dey our blood dey normal.

6. E dey help for WEIGHT LOSS::  E dey help body burn any +1 calories for body.

7. E dey boost IMMUNE SYSTEM::   E dey keep body strong and healthy

8. E dey improve DIGESTION::  E dey help for digestion and elimination ie wen u wan go toilet and e no gree u go lick plenty mango e go help.

9. E dey serve as SKIN CLEANSER::  E dey help comot all dose yama yama wey dey for face like pores and spots come make am fine and fresh like new born baby.

10. E dey serve as CONDITIONER::  E dey also make hair soft and smooth. No go plug mango come dey rub am for ur hair, no b soooo e get procedure u need follow.

No comments:

Post a Comment