Thursday, 30 April 2015
Charlie Boy Wife 'Lady Di' don start to dey watch her weight ooo!!
My people i bin tink say na only sweet 16 like us dey watch weight but person just tell me say one 56 years old mama with 3 pikins dey watch weight so tey she dey chop iron join..hmmm..no be small tin.
Arnaldo Jose (winner of Mister Africa International) don enter Naija
Hmmmm……….. make una come see fine bobo wey win Mister Africa
International 2014, chai the guy fine no be small. The bobo come Niga
yesterday, una know the first thing em chop as he land AMALA with EWEDU soup,
chai hunger don dey catch me…check am out.
Na Me Be Amebo Rose And Na My Diary Be This
As this country take be, Amebo dey everywhere but d tin be sey no one dey for we Naija wey dey talk am for the language wey we dey understand! na so so gramma them go use cover everything! Mtchew! No be sey i dey vex o but how Amebo go take sweet if e no dey for we PIGIN!!! Argh!!! Body just dey bite me sef!
Ok! i don cool down but.... Anyways Na Amebo Diary you dey!! And na like dis e go dey B!!!!!!!!!!!!
Subscribe to:
Posts (Atom)



