Our country Naija na d heart of Africa, For Naija we get plenty tourist centre shey na d Obudu Cattle Ranch for Calabar, abi National War museum for Abia abi na National theater for Lagos. Oya make una see wetin i dey try tell una
1. NAIJA FLAG
Our flag get just two fine colour White nd Green, the white dey represent peace and unity for we country and the green dey represent agriculture. Anoda national image wey fit stand also as our flag na our coat of arm wey get dark shield for centre with eagle on top am, two charger by the sides three wavy sliver band for the body of the shield.
2. NAIJA ACCENT
3. WEATHER CONDITION
We dey enjoy different climate condition wether na rainfall, sunshine abi na humidity we dey enjoy am well. Naija dey hot everytime sake of say of our location but we get normal temperature of 30 degree, but if una like rainy season den the month of may and june na d best months to visit Naija.
4. LAND OF OPPORTUNITIES
Naija na fine country wey dey get fresh business ideas. If you get good money wey u wan use start business nd u get good idea, you go make am for Naija.
5. NAIJA FOOD
Na dis part i dey always like, choi Naija food dey sweet die shey na Amala abi Iyan(pounded yam) abi na fufu abi zobo abi pomo abi Orobo wey u go use step down d food wey u chop, choi!!! i don dey hungry.
6. NAIJA FAMILY
Naija people dey live communal lifestyle. Wheather u b member of d family by blood abi friendship abi by marriage abi by community all of una na one family.
7. HAPPY PEOPLE
Naija people dey always dey happy cos na good thing to dey happy always, d one wey dey always sweet me na wen we dey celebrate occassion like carnival, wedding,independence day etc.
8. NAIJA WOMEN
Naija women dey always dey beautiful and dem dey stand out.
9. FRIENDLYNESS
10. INTELLIGENCE
Naija pple dey naturally intelligent. Naija na the first country for Africa wey go make and launch satellite for this planet.
Chai!! Naija una too much.










No comments:
Post a Comment