Tuesday, 10 October 2017

D DAY WEY I NO GO EVER FORGET ( END FEMALE GENITAL MUTILATION ) 2



I still dey feel pain for my vagina, as I tell mumcy say I still dey feel pain especially wen I wan pee mumcy con explain give me say e go stop small small as I dey grow nd na tradition, say e go make my agemate look me with respect, I happy say if I dey wake for villa I up dey get the respect I suppose get but the feeling con change wen I start to dey see period I con dey get one kind yeye flow wey me no even understand but life continues sha. 

Four years don waka since me nd mumcy go villa, I don write waec, I get am 3As nd 6Cs. Jamb come I pass am with score 250. October dat yr I con get admission into university,  I happy eh! by den plenty fine bobo con dey ask me out, dem go tell me say I fine, I con believe wetin grandma  tell me say I fine pass b4. For my hostel, after Saturday work we dey gist abt sex, everybody dey talk wetin dem know, I con tell dem say me I dey bleed weneva bobo touch me, sometimes i just go him neighbour room go dey gist with the girls dey dey dere until him sleep I go con enter him room sleep cos the pain wey I feel dey different from period pain. Dey con dey look me like lucoze cos dem no understand as me too no understand nd I no for tell mumcy I don dey have sex. Helen con dey look me, she con ask weda I dey mutilated, Chioma con ask which one be mutilation again? I con ansa Helen No with  confidence. Helen con explain say FEMALE GENITAL MUTILATION NA D PARTIAL OR TOTAL REMOVAL OF THE FEMALE GENITAL ORGAN OR ANY FORM OF INJURY WITOUT ANY MEDICAL REASON. MULTILATION CAN ALSI BE REFERRED TO AS CIRCUMCISION.  SHE con further explain give us say e get effect nd reasons why dem dey practice am.