Saturday, 20 June 2015
Iggy Azelea don go dey shop for wedding gown
Iggy and Demi Lovato
This rapper Iggy Azelea don enta shoppin centre for her weddin gown with late late show host James Corden nd guess who will be her bridesmaid........ me!!! lolzzzz no vex oooo no b e o, na her cool frnd Demi Lovato go b her bridesmaid. Incase una no knw who b Demi Lovato den make una go watch dis cartoon FROZEN or instead download 1 of my fav songs "let it go" na she sing am. Oya see foto of Iggy in some wedding dresses.
Happy Ramadan!!!
Ramadan na worldwide celebration by muslims. Dem dey celebrate am on the ninth month according to dem Islamic calendar. Sawn(fasting) dey necessary for everyone except dose wey no well, wey dey pregnant or dey breastfeed, papa nd mama dem wey don old wella, women wey dey see dem period, no dey follo for dis fasting. But wait ooo, If u come start d fast den in btw d fast ur period come wetin dem go do?
People wey dey smoke, drink ogogoro, and pple wey dey always do amebo(abeg no count me oo) etc go stop all dem sinful act sake of say dis period na Holy period to respect Muhammad.
Happy Ramadan.... Make una chop well after una don fast finish ooo.
Thursday, 4 June 2015
GODWIN video don comot
choi finally d official video of GODWIN don comot. d video sharp, fine nd lovely. Thanks to MAVIN record wey make d video confarm, also especially to papa God na u biko. If una wan get d video u go fit get am for yabaleftonline.com or tooxclusive.com . oya see small foto from d video.
Mauritius don get new Presido
10 Naija Entertainers wey everybody love
Subscribe to:
Posts (Atom)







