I dey ten years old i no know wetin dey happen around
me wella, but one christmas holiday like dat wey everybody for our family come
house include cousins wey i never see before, i come dey wander wetin dey
happen, everybody just dey happy anyhow, i come use style ask mumsy wetin dey
happen, she say dem wan celebrate my cousin wey wan marry before she go her
husband side, i come dey wander which other celebration dey again cos my cousin
wedding na like three months to come, she say make i no worry say i go
understand soon.
Mumsy and her sisters commot go market dat day, dem
buy plenty wrapper, boxes, pots and spoons and plenty plenty other fine fine
things for her, i come dey wish say na me dey marry so that dem go buy my own
join. One saturday morning like dat i wake dey hear person dey scream, the
voice na my cousin own, as i wan go look person come touch me say make i no go,
no be my turn. Later dat day dem cook
sweet rice for house with big chicken i chop tire. As holiday finish everybody
go back dem house, as me and mumsy wan commot grandma call me tell me say make
i be good girl o so dat good husband go come marry me like my cousin. I no undastand wetin she mean but
i smile sake of say i see the plenty fine things dem buy for her.
