Tuesday, 10 October 2017
D DAY WEY I NO GO EVER FORGET ( END FEMALE GENITAL MUTILATION ) 2
I still dey feel pain for my vagina, as I tell mumcy say I still dey feel pain especially wen I wan pee mumcy con explain give me say e go stop small small as I dey grow nd na tradition, say e go make my agemate look me with respect, I happy say if I dey wake for villa I up dey get the respect I suppose get but the feeling con change wen I start to dey see period I con dey get one kind yeye flow wey me no even understand but life continues sha.
Four years don waka since me nd mumcy go villa, I don write waec, I get am 3As nd 6Cs. Jamb come I pass am with score 250. October dat yr I con get admission into university, I happy eh! by den plenty fine bobo con dey ask me out, dem go tell me say I fine, I con believe wetin grandma tell me say I fine pass b4. For my hostel, after Saturday work we dey gist abt sex, everybody dey talk wetin dem know, I con tell dem say me I dey bleed weneva bobo touch me, sometimes i just go him neighbour room go dey gist with the girls dey dey dere until him sleep I go con enter him room sleep cos the pain wey I feel dey different from period pain. Dey con dey look me like lucoze cos dem no understand as me too no understand nd I no for tell mumcy I don dey have sex. Helen con dey look me, she con ask weda I dey mutilated, Chioma con ask which one be mutilation again? I con ansa Helen No with confidence. Helen con explain say FEMALE GENITAL MUTILATION NA D PARTIAL OR TOTAL REMOVAL OF THE FEMALE GENITAL ORGAN OR ANY FORM OF INJURY WITOUT ANY MEDICAL REASON. MULTILATION CAN ALSI BE REFERRED TO AS CIRCUMCISION. SHE con further explain give us say e get effect nd reasons why dem dey practice am.
Thursday, 24 August 2017
D DAY WEY I NO GO EVER FORGET ( END FEMALE GENITAL MUTILATION )
I dey ten years old i no know wetin dey happen around
me wella, but one christmas holiday like dat wey everybody for our family come
house include cousins wey i never see before, i come dey wander wetin dey
happen, everybody just dey happy anyhow, i come use style ask mumsy wetin dey
happen, she say dem wan celebrate my cousin wey wan marry before she go her
husband side, i come dey wander which other celebration dey again cos my cousin
wedding na like three months to come, she say make i no worry say i go
understand soon.
Mumsy and her sisters commot go market dat day, dem
buy plenty wrapper, boxes, pots and spoons and plenty plenty other fine fine
things for her, i come dey wish say na me dey marry so that dem go buy my own
join. One saturday morning like dat i wake dey hear person dey scream, the
voice na my cousin own, as i wan go look person come touch me say make i no go,
no be my turn. Later dat day dem cook
sweet rice for house with big chicken i chop tire. As holiday finish everybody
go back dem house, as me and mumsy wan commot grandma call me tell me say make
i be good girl o so dat good husband go come marry me like my cousin. I no undastand wetin she mean but
i smile sake of say i see the plenty fine things dem buy for her.
Wednesday, 16 August 2017
END FEMALE GENITAL MUTILATION
Female genital mutilation na one old practice wey dem dey do for girls
and women dem, and na bad tin dem dey do for deir body sake of say dem dey do
am with force and without permission, oyibo go call am “violation of human right”
and this act don dey since 19 kolombo dat is to say since our papa papa papa
dem time.
So according to World Health Organization (WHO) dem explain FGM for us
as when person commot the outside part of our punani or when dem give you mark
for dere for no reason at all, even if na doctor do am e no still good. FGM/C(Female
Genital Mutilation/ Cutting) na also anoda name for FGM.
Subscribe to:
Posts (Atom)
