Sunday, 13 December 2015

Mercy Johnson Okije Dey Welcome Her Third Pikin

Dem be two later become three, at St Joseph Medical Centre, Baltimore God butter the bread of Mercy Johnson Okojie as em give her safe delivery. Welcome to d family. Congratulations......


Mercy Johnson's third child


Friday, 20 November 2015

THIEF!!! 2 Women Wey Dem Catch With Stolen Meat, Una No Go Believe How Dey Hid Am.


Nawa ooo!!! wonders no go end, dis two Zimbawean women wey dey work 4 farm 4 South Africa don enta wahala with dem oga wen em catch dem with em meat. Wetin scatter my head na d wey dem hid am, dem tie tie d meat for dem body. chai!!


Adorable! North West commot with Ripped jean


This popular most fashionable pikin don commot again with ripped jean as oyibo dey call am. See as she rock d jean wella wit her hair curly curly nd her pink purse looking so adorable. No b d first tyme she dey wear tear tear jean bt she still dey rock am well.


FORMER PRESIDO OGA JONATHAN DON ADD ANODA YEAR TODAY


Our former presido Goodluck Ebele Azikiwe Jonathan aka Oga Jona aka GEJ was born on d 20th of november 1957, so today God don add anoda year to em life. Oga Jona may u live long. Happy birthday.

Friday, 6 November 2015

DJ PRINZY IS +1


DjPrinzy

D youngest dj in Umuahia, Abia state DjPrinzy dey celebrate em birthday today wey b d 6th of novermber 2015, make una come celebrate wit am @De latino BCA road Umuahia. follow am for twitter nd instagram @Dj_prinzy. Happy birthday from Amebodiary nd crew.


Friday, 14 August 2015

Chai!!! dey don put ooni of Ife for ground.........


Finally dey don put Oba Okunade Sijuwade to rest today @  the Enuwa Square, Ooni of Ife's palace. People wey grace dis great occassion  na pple like Vice President Yemi Osinbanjo and other dignitaries.

Saturday, 20 June 2015

Iggy Azelea don go dey shop for wedding gown

                                                 Iggy and Demi Lovato      

This rapper Iggy Azelea don enta shoppin centre for her weddin gown with late late show host James Corden nd guess who will be her bridesmaid........ me!!!  lolzzzz no vex oooo no b e o, na her cool frnd Demi Lovato go b her bridesmaid. Incase una no knw who b Demi Lovato den make una go watch dis cartoon FROZEN or instead download 1 of my fav songs "let it go" na she sing am. Oya see foto of Iggy in some wedding dresses.

Happy Ramadan!!!


Happy Ramadan

 Ramadan na worldwide celebration by muslims. Dem dey celebrate am on the ninth month according to dem Islamic calendar.  Sawn(fasting) dey necessary for everyone except dose wey no well, wey dey pregnant or dey breastfeed, papa nd mama dem wey don old wella, women wey dey see dem period, no dey follo for dis fasting. But wait ooo, If u come start d fast den in btw d fast ur period come wetin dem go do?
  People wey dey smoke, drink ogogoro, and pple wey dey always do amebo(abeg no count me oo) etc go stop all dem sinful act sake of say dis period na Holy period to respect Muhammad.

 Happy Ramadan.... Make una chop well after una don fast finish ooo.

Thursday, 4 June 2015

GODWIN video don comot


choi finally d official video of GODWIN don comot. d video sharp, fine nd lovely. Thanks to MAVIN record wey make d video confarm, also especially to papa God na u biko. If una wan get d video u go fit get am for yabaleftonline.com or tooxclusive.com . oya see small foto from d video.




Mauritius don get new Presido


Dis African country don get new presido, and na woman she b. Ameenah Gurib-Fakim na d 1st female president wey dis country go get, and she b d 3rd for Africa as a continent. Congrats madam, wish u success as u rule.

10 Naija Entertainers wey everybody love



Apart from say dem popular, dem don take over Naija entertainment industry with dem style, talent and good looks. All of dem don make Naija proud all around the world, winning plenty plenty awards.

Sunday, 24 May 2015

One Year Don Waka For Kim Kardashian And Kanye West


Today na exactly one year wey Kanye West carry Kim Kardashian go Alter make dem wed. Congratulation to dem. Make una see foto from dat wedding day.

Saturday, 23 May 2015

Better Way To Dey Healthy


Some  pple no sabi chop food, dem go jst dey chop anyhow. To dose wey dey work oyibo work, wey make una  dey miss morning food, shey u knw say if u no chop food for morning u no go concentrate wella for wetin u dey do.

Friday, 22 May 2015

Colourful foto of Miss Kedike


Winner of MTN project fame 2010 Chidinma Ekile aka Miss Kedike jst dey kill us with her beauty. she just released dis fine foto of her self looking sweet and colourful. fine fine sisi.

Sen.David Mark Gift to President Goodluck Ebele Jonathan (GEJ)


Choi!!! you wan try, see wetin dem say Oga David Mark give our presido GEJ as gift. Dey say d watch cost $200.000 and e dey customized with gold. Dey even Oga Jona name ontop am. But the watch fine ooo sake of say dem put out coat of arm inside the glass. 

Naomi Campbell dey +1 today


Naomi Campbell @ 45

Today na the birthday of a popular Model, Singer, Actress Naomi Elaine Campbell. She don add 1 to the 44years she done already spend for life. Her 45th birthday go shele tomorrow  for south france with her padi dem nd her fyn bobo. Amebodiary dey say happy birthday and more years ahead.

Tuesday, 19 May 2015

Celebrities wey show for 2015 Billboard music award


hmmm!!! people dey dress, make una see dress of different styles for dis event.

Lady Gaga's wedding dress to be made by Vera Wang


The popular singer Lady Gaga dey engaged by her long time boyfriend now fiance Taylor Kinney,

Monday, 18 May 2015

Kanye West and Kim Kardashian wan renew dem vow


Kim and Kanye West Anniversary
Una knw our popular tv star Kim Kardashian nd her hubby Kanye West wey marry last year for Italy wan renew dem vows to celebrate dem one year wedding anniversary together. Person wey dey close to dem say na on top Eiffel tower for Paris.

Tiwa Savage's Baby shower for Yacht.


Chai!!! Money good oo see as Marvin record first lady take celebrate her baby wey dey come,

Friday, 15 May 2015

Plenty things Mango dey do for our Body


Our market don full with different types of fruit but d 1 wey u go see pass for market now na mango sake of say na the season #namangoseason.

Edo state Governor Adams Oshiomhole don re-marry



Five years don waka wey Comrade Adams Aliyu Oshiomhole former wife Mrs. Clara die of cancer.

Everybody dey trek go see Gen. Buhari and other governors wey dey elect




Nawa ooo since d day Suleiman Hashimu trek from Lagos reach Abj, jst make em congratulate Gen. Buhari since den everybody don follow dey trek.

Tuesday, 12 May 2015

Mike Adenuga wan buy anoda telephone company


No be joke, Mike Adenuga d owner of Globacom Nigeria, wan buy anoda telephone company for ivory coast,

Sunday, 10 May 2015

10 ogbonge reasons why Naija na d best country on Earth






Our country Naija na d heart of Africa, For Naija we get plenty tourist centre shey na d Obudu Cattle Ranch for Calabar, abi National War museum for Abia abi na National theater for Lagos. Oya make una see wetin i dey try tell una

Thursday, 7 May 2015

3 ogbonge tinz wey u go do to make am for business by Kim Kardashian West


Kim Kardashian West say she get 3 rules wey she get for em business, and i believe say e dey work for her cos apart from the video game she get, she jst lauch her new book wey she title SELFIE.

Jennifer Lopez aka Jlo no dey carry last



She be Actress, Singer, Dancer, television star, come become mama on top everytin, still she dey sexy and fit like sweet 16

Great grandma don go visit her princess

Prince Williams and his pretty wife Kate Middleton dey very happy to welcome their pikin Princess Charoltte Elizabeth Diana,

Monday, 4 May 2015

Ogbonge pple wey show for Mayweather and Pacquiao Fight





the ogbonge fight wey happen for saturday morning btw Floyd Mayweather Jr. and Manny Pacquiao no be small.

Sunday, 3 May 2015

Fuel don Scarce For Naija



nawa ooo i tink say na joke wen i hear say fuel dey scarce for Ibadan, Lagos, Abuja, Abia, i no say dey mean business,

Friday, 1 May 2015

Michelle Aigbe Get Fashion Sense Like Her Mama (Mercy Aigbe)



Una don see am dey say if ur mama wowo you sef go wowo if your papa come wowo join your mama own na double wahala be dat bt if ur mama fine like Mercy Aigbe......

Don Jazzy Don Waka From Naija Go Yankee Watch Fight

 
Our Own Don Baba Jay (Don Jazzy) don go obodo oyibo mek watch fight wey dey between
Mayweather And Pacquiao