Saturday, 23 May 2015
Better Way To Dey Healthy
Some pple no sabi chop food, dem go jst dey chop anyhow. To dose wey dey work oyibo work, wey make una dey miss morning food, shey u knw say if u no chop food for morning u no go concentrate wella for wetin u dey do.
Oya make i tell u better way wey u fit live better better life.
1. Dey chop small food wella
2. If you wan chop food for nyt abeg chop am by 7 sake of say e go digest b4 u climb ur bed, if una say dat tyme dey too early, make una chop b4 9:00pm.
3. Make sure una dey take plenty water wen u chop finish, dem say e dey help push d food wey we don chop.
4. Make sure una chew una food wella b4 u swallow am, like if u dey chop yam dey chew am like 30sec or if na bread since dat 1 dey soft dey chew am for 5-10 secs b4 u swallow am.
5. No dey chop plenty sugar sugar food, dey say e dey go pack for belle, e dey add to d fat wey dey for body.
I no go lie dis kin thing no dey easy for anybody xpect say u dey watch weight or u b model but dis thing dey work wella.

No comments:
Post a Comment