Ramadan na worldwide celebration by muslims. Dem dey celebrate am on the ninth month according to dem Islamic calendar. Sawn(fasting) dey necessary for everyone except dose wey no well, wey dey pregnant or dey breastfeed, papa nd mama dem wey don old wella, women wey dey see dem period, no dey follo for dis fasting. But wait ooo, If u come start d fast den in btw d fast ur period come wetin dem go do?
People wey dey smoke, drink ogogoro, and pple wey dey always do amebo(abeg no count me oo) etc go stop all dem sinful act sake of say dis period na Holy period to respect Muhammad.
Happy Ramadan.... Make una chop well after una don fast finish ooo.
No comments:
Post a Comment