Thursday, 24 August 2017

D DAY WEY I NO GO EVER FORGET ( END FEMALE GENITAL MUTILATION )



 

I dey ten years old i no know wetin dey happen around me wella, but one christmas holiday like dat wey everybody for our family come house include cousins wey i never see before, i come dey wander wetin dey happen, everybody just dey happy anyhow, i come use style ask mumsy wetin dey happen, she say dem wan celebrate my cousin wey wan marry before she go her husband side, i come dey wander which other celebration dey again cos my cousin wedding na like three months to come, she say make i no worry say i go understand soon.
Mumsy and her sisters commot go market dat day, dem buy plenty wrapper, boxes, pots and spoons and plenty plenty other fine fine things for her, i come dey wish say na me dey marry so that dem go buy my own join. One saturday morning like dat i wake dey hear person dey scream, the voice na my cousin own, as i wan go look person come touch me say make i no go, no be my turn.  Later dat day dem cook sweet rice for house with big chicken i chop tire. As holiday finish everybody go back dem house, as me and mumsy wan commot grandma call me tell me say make i be good girl o so dat good husband go come marry me like  my cousin. I no undastand wetin she mean but i smile sake of say i see the plenty fine things dem buy for her.
 
 five years don waka, me and mumsy go villa but dis time na just my aunties and some of my cousins wey be age mate with me, two days later we go market, dis time i follow dem with my cousins dem, dem say make we pick any anything wey we want, na so i pick fine clothes, we buy finish come go house. For night granny call us tell us tori, after the tori she say make we go sleep say we dey commot tomorrow morning, as i like to dey ask question too much i ask where we dey go,  she talk say  na party, we come happy well well.
Morning don reach, three of us wear our fine cloth wey dem buy for us, follo granny, mama and aunt dem for back. As we reach we enter one room, na only one mat dey dere with one small stool, i no talk till one older woman enter with small bag, follo by granny and mumsy and aunt dem and some other girls and deir mama dem, and some women wey i neva see before, the last person wey enter lock down, fear catch me but i dey smile cos mumsy say she go carry me go anywhere i wan go wen we reach house.
D older mama wey enter with bag come pour her bag out, i see small knife with some other thing wey i no know, i look my mumsy she dey smile. D mama come point me say make i come lie down for the mat, i no gree but one woman and my aunt catch me, put me for ground raise my fine dress up come open my legs and the next thing wey i feel na pain for my vagina, the older mama just dey cut dey cut , she no even look my face as she dey do am, i dey scream dey shout make mumsy help me, i dey beg aunt make she leave me but d older mama just dey cut dey go, i cry so teh i no fit open mouth again. As dem carry me put for anoda room my fine dress don soak with blood i just dey cry... Granny come meet me tell me say “ you be true daughter of your mama, see as you come fine now pass before”, as she dey tell me all dis things dey praise me, i dey hear d oda girls dem wey still dey dat room, dey cry.
 As we go back house i still dey feel d pain, mumsy come tell me say make i no tell anybody wetin happen for villa, as we go school me and my friends come dey gist  how we take enjoy our holiday, d first girl talk her own holiday as e take go, as she dey explain give dem, my mind don go far i just dey see d face of dat older woman as she tell me come, i come feel d sharp pain of d knife wey  she hold and i come dey cry true true, as dem see say i dey cry na em dem come ask me wetin happen sake of say wetin dem dey talk about no need tears, i come dey wander how i wan take explain to my friends say i go villa with my mumsy and dem cut me with knife...

To be continued.......


No comments:

Post a Comment