Tuesday, 10 October 2017
D DAY WEY I NO GO EVER FORGET ( END FEMALE GENITAL MUTILATION ) 2
I still dey feel pain for my vagina, as I tell mumcy say I still dey feel pain especially wen I wan pee mumcy con explain give me say e go stop small small as I dey grow nd na tradition, say e go make my agemate look me with respect, I happy say if I dey wake for villa I up dey get the respect I suppose get but the feeling con change wen I start to dey see period I con dey get one kind yeye flow wey me no even understand but life continues sha.
Four years don waka since me nd mumcy go villa, I don write waec, I get am 3As nd 6Cs. Jamb come I pass am with score 250. October dat yr I con get admission into university, I happy eh! by den plenty fine bobo con dey ask me out, dem go tell me say I fine, I con believe wetin grandma tell me say I fine pass b4. For my hostel, after Saturday work we dey gist abt sex, everybody dey talk wetin dem know, I con tell dem say me I dey bleed weneva bobo touch me, sometimes i just go him neighbour room go dey gist with the girls dey dey dere until him sleep I go con enter him room sleep cos the pain wey I feel dey different from period pain. Dey con dey look me like lucoze cos dem no understand as me too no understand nd I no for tell mumcy I don dey have sex. Helen con dey look me, she con ask weda I dey mutilated, Chioma con ask which one be mutilation again? I con ansa Helen No with confidence. Helen con explain say FEMALE GENITAL MUTILATION NA D PARTIAL OR TOTAL REMOVAL OF THE FEMALE GENITAL ORGAN OR ANY FORM OF INJURY WITOUT ANY MEDICAL REASON. MULTILATION CAN ALSI BE REFERRED TO AS CIRCUMCISION. SHE con further explain give us say e get effect nd reasons why dem dey practice am.
REASON why dem dey practice am
1. For cleanliness: Dem say if dem cut her external genitals say she go dey clean nd e dey promote good hygiene.
2. For acceptability among her community: Dey say if she no cut am say she no fit follo her mate waka nd she no fit perform any traditional rite for her community.
3. For marriageability: If she no dey cut she no fit marry anyone in her community, she no fit marry anyone.
4. For cultural nd religious requirement: Once you dey cut if you commot from your community anybody wey see u go know where you come from. Na also an act of initiation into womanhood.
5. For fertility nd child survial: Dey say e dey promote fertility nd pikin make e dey alive, dey say if the child's head touches the woman's clitoris the child is believed to die.
Effect:
1. Trauma
2. Irregular menstrual flow
3. Pain during sex
Sometimes death
As she talk finish everybody con dey look, Chioma just shout JESUS! so some people still dey do dis kind thing. Helen con nada YES, she con face me again; so are you mutilated? well I think so I ansad. I con explain wetin I fit remember, as e take happen to me. she even go as far as showing us a video for her pc. As we watch am finish tears just dey run down my eyes, I no dey cry say dem do am to me, I dey cry say na dis kind thing my sis go pass through cos dem no do am for her as she small cos she sick wella dat time.
So with Helen help nd her friends dey dey fight against dis act con go my villa tell them wetin this dey cause.for dem children nd every other thing. E no dey easy ooooo but I dey happy say dey don end am for my villa.
So u too fit end am for your community.
EndFGM today
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment