Thursday, 30 April 2015
Charlie Boy Wife 'Lady Di' don start to dey watch her weight ooo!!
My people i bin tink say na only sweet 16 like us dey watch weight but person just tell me say one 56 years old mama with 3 pikins dey watch weight so tey she dey chop iron join..hmmm..no be small tin.
The woman wey i dey yarn about na no other person but our area fada wife Dianne Oputa aka Lady Di, Charlie boy Wife.
As d tori dey go, she talk sey she wan dey in shape for her hubby.Hmmm...Lovi lovi still dey carry dis ones.
So all those mama dem wey if dem marry dem go live dem sef to dey swell like bread wey soak for water, after u go dey complain say ur husband dey follow small small pikin. how him no go follow them if everytime him come house na only rapper u dey put for chest. well mek e no be like say i don dey too talk sha!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)




No comments:
Post a Comment