Friday, 15 May 2015
Plenty things Mango dey do for our Body
Our market don full with different types of fruit but d 1 wey u go see pass for market now na mango sake of say na the season #namangoseason.
Oya make i give una 10 things wey go make us dey chop Mango everyday;
1. E dey prevent CANCER:: E dey protect against Cancer, Leukemia, and Prostrate cancer
2. E dey lower CHOLESTEROL:: E get high level of vitaminC and e dey help lower serum cholesterol
3. E get high IRON for women:: Mango dey rich in iron. E get natural solution for people wey dey suffer from Anemia. E dey increase both iron and calcium level for both pregnant women and women wey don reach menopause.
4. E dey protect EYE:: 1 slice of Mango dey supply 25% of vitamin A wey we need daily for our eyes, e dey even prevent night blindness and dry eyes.
5. E dey help DIABETES:: E dey help the insulin level wey dey our blood dey normal.
6. E dey help for WEIGHT LOSS:: E dey help body burn any +1 calories for body.
7. E dey boost IMMUNE SYSTEM:: E dey keep body strong and healthy
8. E dey improve DIGESTION:: E dey help for digestion and elimination ie wen u wan go toilet and e no gree u go lick plenty mango e go help.
9. E dey serve as SKIN CLEANSER:: E dey help comot all dose yama yama wey dey for face like pores and spots come make am fine and fresh like new born baby.
10. E dey serve as CONDITIONER:: E dey also make hair soft and smooth. No go plug mango come dey rub am for ur hair, no b soooo e get procedure u need follow.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment