Sunday, 10 May 2015

10 ogbonge reasons why Naija na d best country on Earth






Our country Naija na d heart of Africa, For Naija we get plenty tourist centre shey na d Obudu Cattle Ranch for Calabar, abi National War museum for Abia abi na National theater for Lagos. Oya make una see wetin i dey try tell una

1. NAIJA FLAG

                    Our flag get just two fine colour White nd Green, the white dey represent peace and unity for we country and the green dey represent agriculture. Anoda national image wey fit stand also as our flag na our coat of arm wey get dark shield for centre with eagle on top am, two charger by the sides three wavy sliver band for the body of the shield.

2. NAIJA ACCENT

                    CNN Global Experience talk say for the whole of Earth we get sexy accent and we be d fifth. Naija i dey hail oo

3. WEATHER CONDITION


                     We dey enjoy different climate condition wether na rainfall, sunshine abi na humidity we dey enjoy am well. Naija dey hot everytime sake of say of  our location but we get normal temperature of 30 degree, but if una like rainy season den the month of may and june na d best months to visit Naija.

4. LAND OF OPPORTUNITIES

                     Naija na fine country wey dey get fresh business ideas. If  you get good money wey u wan use start business nd u get good idea, you go make am for Naija.

5. NAIJA FOOD
                            
                    Na dis part i dey always like, choi Naija food dey sweet die shey na Amala abi Iyan(pounded yam) abi na fufu abi zobo abi pomo abi Orobo wey u go use step down d food wey u chop, choi!!! i don dey hungry.

6. NAIJA FAMILY

                    Naija people dey live communal lifestyle. Wheather u b member of d family by blood abi friendship abi by marriage abi by community all of una na one family.

7. HAPPY PEOPLE

                    Naija people dey always dey happy cos na good thing to dey happy always, d one wey dey always sweet me na wen we dey celebrate occassion like carnival, wedding,independence day etc.

8. NAIJA WOMEN

                    Naija women dey always dey beautiful and dem dey stand out.

9. FRIENDLYNESS

                    Naija pple dey friendly to everyone especially to visitors sake of say we dey welcome dem with open hands and warm invitation.

10. INTELLIGENCE

                    Naija pple dey naturally intelligent. Naija na the first country for Africa wey go make and launch satellite for this planet.

Chai!! Naija una too much.

No comments:

Post a Comment