Wednesday, 16 August 2017

END FEMALE GENITAL MUTILATION



EndFGM
           
 Female genital mutilation na one old practice wey dem dey do for girls and women dem, and na bad tin dem dey do for deir body sake of say dem dey do am with force and without permission, oyibo go call am “violation of human right” and this act don dey since 19 kolombo dat is to say since our papa papa papa dem time.  
  So according to World Health Organization (WHO) dem explain FGM for us as when person commot the outside part of our punani or when dem give you mark for dere for no reason at all, even if na doctor do am e no still good. FGM/C(Female Genital Mutilation/ Cutting) na also anoda name for FGM.

  Dis act no get age, dem fit do am when the pikin still dey like 9months old or when dey enter teenage age or when she wan marry. About 200millon girls and women do already do this thing and most of dem survive am, and 3million girls dey at risk every year. some people think say na only village people dey do am but my dear people e dey even happen for city even for obodo oyibo. You no go believe say 32% of women wey dey don cut dey city and na only 19% of dem dey villa.
   Different people dey do am for nija, as nija take big reach with over 250 ethnic groups, 27% of nija women don dey cut. abeg make una help me calculate, if 27% of nija women don dey cut true dis act, abeg wetin remain?

TYPES
(I)              Clitoridectomy  na when dey commot small part of the clitoris, or when dey commot all the clitoris.
(II)          Excision  na when dey commot all the clitoris and the labia minora.
(III)       Infibulation na when dey commot i and ii den dem go sow am, come leave small opening for wewe and monthly flow.
(IV)      Den dis one na the one wey dem dey call unclassified, dem dey do plenty plenty thing like piercing, pricking, pulling and scraping.

Una know say dis act get effects, some of the effect na;
·       Shock
·       Menstrual pain
·       Trauma
·       Wound healing problem
·       Infections
·       Sometimes Death
·       Excessive bleeding
       
      Some nija people still dey practice am sake of say na deir culture and if you no do am you no fit marry, some go say dem dey dirty, some go say the person go dey follow man up and dan, some even say when dey wan born pikin say bad thin go happen to the pikin and the mama. 
      Hmmmm!!!! the truth about the matter be say as we dey grow as a country make we dey grow as people too, make we dey respect one another. Our girl pikin get bright future abeg make we no allow tradition wey our papa papa papa papa papa papa papa dem bin dey do dat time wey dem never born us come dey block road for us . Abeg make we join hands together end dis act, eh!! tradition good e dey help us know things about places wey we come from but for this our time dis kind tradition na bad thing......... 


      Ameborose dey say NO to FGM/C
      Save our girls and women.

No comments:

Post a Comment